-
Proverbs 7
Warning Make You No Follow Ashawo My son, keep my words and put di beta-beta-tins wey I tell you for your heart. Do wetin I tell you and you go live; keep wetin I teach you like di apple of your eye. Tie dem join your fingers; write dem inside di book of your heart. Tell wisdom sey, “You be my sista,” con call understanding your broda. So dat dem go keep you from ashawo, and from olosho—wit her sweet-mouth. From di window of my house nahin I look, from my curtain, I look among di ordinary pipo, I notice among di youths—one young man wey no get-sense. He dey…
-
Proverbs 6
Warning Make You No Be Mugu My son, if you don stand as guarantor for your padi, if you don agree to be guarantor for jjc, if wetin you tok don hold-you-for-work, or your mouth don catch you, make you do dis tin my son, and free yourself—becos you don fall inside your padi hand. Go, con humble yourself. Beg your padi! No close your eyes con sleep, no let sleep carry you go. Free yourself, like bush-meat from hunter hand, and like bird from hunter hand. Chai lazy man; go meet ant, reason dem and make you get-sense! Dem no get oga, chairman, or oba wey dey rule dem,…
-
Proverbs 5
Warning Make You No Climb Pesin Husband Or Wife My son, put ear for ground—hear my wisdom, listen well-well to my understanding, so dat you go fit keep common sense, and your lips go tok knowledge. Honey dey drop from ashawo lips, and her words smooth pass ororo. But las-las, she bitter well-well like poison, and she sharp like sword wey get two sides. Her leg dey waka go kpeme, her road dey go straight to grave. So dat you no go reason her life, her way no straight, sote you no-fit understand dem. Now my pikin, make you hear me now; no fashi wetin I dey tok. Waka far…