1st Chronicles

  • 1st Chronicles

    1st Chronicles Chapter 29

    Gift For Building Baba-God House To add-join, naso David di king tell everi pesin wey gada sey, “My pikin Solomon—di one wey Baba-God don choose, na small boy and he no get experience. Di work big becos dis no be palace for man, but na Baba-God house. I don use all my pawa take prepare for di house of my God—gold for di gold work, silver for di silver work, bronze for di bronze work, iron for di iron work, and wood for di wood work, and even onyx stones, and stones wey dem go set, stones wey dey shine, different-different colors of stones, plus everi kind of fine-fine-stones, plus…

  • 1st Chronicles

    1st Chronicles Chapter 28

               David Plan For Baba-God House So David call all di princes [officials] of Israel to gada for Jerusalem; di princes of di tribes, plus di captains of di groups wey dey serve di king, di captains of thousand men plus di captains of hundred men, and di officers wey dey in charge of all di property plus animals wey belong to di king plus hin sons, togeda wit di palace officials, di strong men, plus all di fighters wey get-mind. Naso King David stand up con tok sey, “Make una listen to me, my brodas and my pipo. I bin get am for mind to build house as place…

  • 1st Chronicles

    1st Chronicles Chapter 27

        Leaders of Di Army Na dis be di numbas of di pipo of Israel, family leaders, commanders of thousands, commanders of hundreds, plus dia officers wey dey serve di king for everi mata about di military groups. Everi group serve for one month of di year; everi group get 24,000 men. Jashobeam wey be di son of Zabdiel nahin dey in charge of di first group, wey dey in charge of di  first month. Hin group get 24,000 men. Jashobeam na di pikin-pikn-pikin of Perez and nahin dey in charge of all di army officers for di first month. Dodai wey be Ahohite nahin dey in charge of di…

No copy from dis website