Proverbs 24
- No envy wicked men, no wish to stay wit dem.
- Dem dey plan to shed blood for dia heart, and dia lips dey tok as dem wan take cos wahala.
- Na wit wisdom pipo take dey build house, and na wit understanding—house take dey stand gidigbam.
- Wit knowledge, di rooms go full wit everi fine-fine-tins, plus good tins.
- Wise man strong kakaraka, eehn..man wey like to learn go get more-more power.
- You need guidance to plan for war, and plenty advisers dey bring safety.
- Mumu head no-fit carry wisdom; he no get anytin to tok for meeting.
- Dem go know pesin wey dey plan evil as badbelle pesin.
- Yeye tinking na sin, and pesin wey no-get-sense na tufiakwa for men.
- If you fall on di day wen kasala burst, your power neva reach be dat!
- Save pesin wey dey waka go kpeme; hold pesin wey dey stagger dey go where dem go kill am.
- If you tok sey, “But we no know anytin about am.” Abi you tink sey Baba-God wey dey judge pesin heart no dey reason?”
Abi Baba-God wey dey guard your soul—no know wetin sup? Abi he no go pay everi-pesin based-on wetin dem don do?
- Chop honey, my pikin, becos honey good, honey wey sweet for your mouth.
- Naso wisdom sef sweet for di soul if you sabi am; if you fyne wisdom, you don get bright future, and your hope no go cut komot.
- Oh wicked man, make you no attack righteous man house, no rob hin house.
- Righteous man fit fall seven times, he go rise up again, but kasala dey bring wicked pipo down.
- No dey laff wen your enemy fall; no dey happy wen your enemy stagger,
- or Baba-God go see am, and he no go happy—con turn hin vex komot from am.
- No let evil men dey make your heart cut, or jealous wicked pipo.
- Evil man no get bright future, and wicked pesin lamp go off.
- My son, fear Baba-God and di king, and no join pipo wey dey tok about change, and wey wan rebel.
- Dia palava go start sharply, and who know di kain punishment wey both di king and Baba-God fit carry come?
- Dis one sef na wise words; e no good make pesin dey use partiality judge mata.
- Any-pesin wey tell wicked pesin sey, “You be good pesin,” pipo go curse am and nations go hate am.
- But e go beta for pipo wey condemn wicked pipo, and dem go get beta blessings.
- Correct ansa be like kiss for lips.
- Arrange your business for outside, arrange your land, afta dat build your house.
- No bad-mouth your neighbour for any reason, abi you go use your lips do wayo?
- No tok sey, “I go do am back wetin he do to me; I go pay dat man back for wetin he do me.”
- I waka pass lazy man farm, I waka pass di grape-farm of pesin wey no-get-sense.
- Shuku-shuku full everi-where, grass don grow full all di ground, and di fence don kpafuka.
- Wen I see am, I reason wetin I observe—con learn lesson from wetin I see.
- Small sleep, small rest, and make pesin fold hin hand relax small—
- and before you know, poverty go show like tiff, and your bills go meet you like armed robber.