Proverbs 7
Warning Make You No Follow Ashawo
[wpdm_package id=’1260′]
- My son, keep my words and put di beta-beta-tins wey I tell you for your heart.
- Do wetin I tell you and you go live; keep wetin I teach you like di apple of your eye.
- Tie dem join your fingers; write dem inside di book of your heart.
- Tell wisdom sey, “You be my sista,” con call understanding your broda.
- So dat dem go keep you from ashawo, and from olosho—wit her sweet-mouth.
- From di window of my house nahin I look, from my curtain,
- I look among di ordinary pipo, I notice among di youths—one young man wey no get-sense.
- He dey waka for street near her sharp-corner, and he dey waka go di road of her house,
- for evening, as di day dey fade, as night start to dey dark.
- Naso one woman just come meet am, she baffup like ashawo wey carry bad tin for mind.
- She too razz, she be gbagbati, and her leg no dey gree stay for house.
- Now-now-now she dey for street, before you know she don waka go village square, she dey perch for everi sharp-corner.
- She hollam con dey kiss am, she bone-face con look am straight, con tell am sey,
- “I get peace offerings wit me; today I don pay my vows.
- So I come out to meet you; I fyne you taya and now I don see you!
- I don use fine cloth take arrange my bed—fine Egyptian linen wit colours.
- I don pour perfume for my bed wit myrrh, aloes and cinnamon.
- Come make we jogodo well-well wit love till early mor-mor, make we flex wit love!
- My husband no dey house; he don travel go far-far.
- He carry bag of moni, and he no go come house until di time wey he tok.”
- Wit sweet-mouth naso she take confuse am, she use her sweet-mouth hollam for work.
- He follow her sharp-sharp like nama wey dem wan go kill, like animal wey dey waka enta trap,
- until arrow go shuuk hin liver. He be like bird wey dey rush enta trap—he no just know sey di tin go kill am.
- So make you listen to me now, my pikin, hear wetin I dey tell you.
- No let your heart turn go her road, or waka miss-road enta her way.
- She don fall many men hand; and all di pipo wey she don kill na strong men.
- Her house na express road to grave, wey dey go down to di house of death.
